GPT-4: Wetin be ChatGPT and GPT4 wey evri body dey tok about – BBC
OpenAI, di company behind di viral chatbot ChatGPT, don release new version of dia artificial intelligence system.
Dis release dey come few months afta dem first launch ChatGPT for November 2022.
But di artificial intelligence research lab, OpenAI say GPT-4 dey more creative, less likely to make up facts and less biased dan di one wey dey before, dat na ChatGPT.
As many pipo dey tok and search about ChatGPT and GPT-4, some odas dey wonder wetin dem be? and why so much tok-tok about dem all of a sudden?
Wetin be ChatGPT?
ChatGPT na Artificial Intelligence Technology chatbot wey OpenAI company found and launch for November 2022.
OpenAI na artificial intelligence research firm wey im founders include Elon Musk.
Artificial Intelligence (AI) Technology chatbots dey designed to answer questions and find information. ChatGPT na di best-known example.
E fit write essays, scripts, poems, and solve computer coding as human-like way. E fit also do conversations and admit mistakes.
Di GPT…
The post GPT-4: Wetin be ChatGPT and GPT4 wey evri body dey tok about – BBC first appeared on SEO, Marketing and Social News | OneSEOCompany.com.
source: https://news.oneseocompany.com/2023/03/15/gpt-4-wetin-be-chatgpt-and-gpt4-wey-evri-body-dey-tok-about-bbc_2023031542069.html
Your content is great. However, if any of the content contained herein violates any rights of yours, including those of copyright, please contact us immediately by e-mail at media[@]kissrpr.com.